NNPCL Chief Corporate Communications Officer, Olufemi Soneye, don invite former President Obasanjo make e come see di refineries wey don dey work now. E talk say di invitation na to show di company commitment to transparency and accountability.
Dis invitation follow Obasanjo comment wey e make, as e tok about di failed plans to privatize Nigeria refineries and di money wey government management don waste.
Soneye assure Nigerians say di work for Port Harcourt Refining Company (PHRC) and Warri Refinery no be ordinary maintenance, but full overhaul to meet global standards. E still add say dis same overhaul dey go on for di old Port Harcourt and Kaduna refineries.
E also clear di air say di tori wey dey go round say NNPCL wan stop crude oil supply to Dangote Refinery no get truth. Soneye talk say di new NNPCL dey focus on improving di refineries and maintaining dem to global standards.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/nlc-don-insist-make-government-withdraw-di-tax-reform-bills/