The Group Chief Executive Officer of Nigerian National Petroleum Company Limited,
NNPCL, Mr Mele Kyari don talk say di company no dey plan to increase di price of Premium Motor Spirit, wey dem dey call petrol.
Wen e yan afta private meeting with di President for Presidential Villa today, Kyari yan say di prices still dey the same and the long queues wey dey some petrol stations for some parts of di country na because people dey rush buy am, and e talk say Nigeria get more dan 1.4 billion liters of petrol for stock. E add say di Federal Government dey work on the wahala wey Oil Marketers dey get wit access to foreign exchange. The NNPCL GMD still yan say no be true say di Federal Government don start to dey pay petrol subsidy again.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905