NLC and TUC don talk say dem go begin nationwide strike wey no get end date from October 3rd.

September 27, 2023

NLC president Joe Ajaero and TUC president Festus Osifo don yan for news after dem Emergency National Executive Council (INEC) meeting for Abuja on Tuesday. Dem talk say dem go start indefinite strike from October 3, 2023, because government no dey look the wahala wey Nigerians dey face as dem remove petrol subsidy. Dem tell state chapters to prepare for protests.

Meanwhile, Minister of Labour and Employment Simon Lalong don beg NLC leaders make dem no go on top the strike wey dem wan start, and e talk say Federal Government dey ready to solve the wahala wey dem talk.

More Posts