The Governor of Central Bank of Nigeria (CBN), Godwin Emefiele, don tok say Nigerians go soon fit to dey short codes subscribe to the e-Naira digital currency.
Emefiele, wey give dis expo on Thursday for the eNaira Hackathon grand finale for Abuja, tok say by next week, both Nigerians wey get bank account and the ones wey no get, go fit to open eNaira wallet and do transactions by simply dialing *997# from their mobile phones.”
Presido Muhammadu Buhari, don launch the eNaira for October 2021 as Africa’s first Central Bank Digital Currency, with the first phase focus on banked users, while the second phase go dey around financial inclusion.
The CBN Governor been don accuse Nigerian banks of frustrating the digital currency, say CBN still dey fight to make the banks accept am.