The Nigerian Association of Road Transport Owners (NARTO) don suspend the nationwide strike wey dem plan.
NARTO members bin threaten to close down operation nationwide from Monday sake of the high cost of diesel, wey dem dey use power their trucks for the movement of petroleum products across Nigeria.
But after their meeting with the Federal Government and other stakeholders on Monday, NARTO direct their members to ensure say normal operation dey continue as dem consider the pains wey Nigerians dey go through.