Nigeria go lead $7.7trn global halal market

September 19, 2024

Vice President Kashim Shettima don hint say Nigeria go become number one hub for opportunities inside the global halal economy, wey dem project go reach $7.7 trillion market value by 2025. Shettima yarn this one yesterday during the Halal Economy Stakeholders Engagement Programme for Banquet Hall, Presidential Villa, Abuja. E talk say Nigeria economic and population size dey give the country better position to attract investment from the global halal economy. But Nigeria gatz check wetin dey weak am and focus on wetin e strong to achieve this economic success.

Halal na Arabic word wey mean lawful, wetin dem permit or permissible. For Nigeria, we get over 100 Halal-certified products, and people spend about $107 billion on top dem products for 2022. Minister of Finance and Coordinating Minister of the Economy, Wale Edun, talk say Halal products no be only for Muslims. E add say this one give Nigeria big opportunity for fast growth, improve competitiveness, and help us boost exports.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/nigerias-inflation-rate-don-drop-to-32-15-for-august/

More Posts