President Bola Tinubu don assure global investors say hin government go remove any obstacle wey dey make am hard to do business for Nigeria. Tinubu yan dis one for the Nigeria-Qatar Business and Investment Forum wey happen for Doha on Sunday.
Tinubu tell genuine investors say make dem report any official wey dey block progress or dey ask for bribe directly to am. E talk say Nigeria dey ready for serious business as hin government go tackle the entrenched interests wey dey spoil confidence for investors for the country.
Tinubu talk say the fight against corruption and insecurity for Nigeria don strong well-well as dem don appoint Nuhu Ribadu, wey be former Chairman of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), as National Security Adviser (NSA).
The Emir of the State of Qatar, His Highness, Sheikh Tamim bin Hamad Al Thani, yan say Qatar dey open to President Tinubu investment move. E talk say e travel go Nigeria for 2019 based on say e believe say Nigeria dey important and strategic ally on its own and within the context of its role for regional matters.