Niger President Dey In ‘Good Spirit’ Even As Dem Hold Am For Station.

August 14, 2023

Niger’s president, Mohamed Bazoum, dey in “high spirits” even though e dey inside “challenging” conditions as di junta wey remove am from power dey hold am, according to him doctor after one visit.

Mohamed Bazoum, him son and him wife don dey inside di basement of him palace for Niamey since di coup wey happun on July 26. Di doctor talk say “Living conditions however remain difficult, with the electricity still cut off in the country.” Reports talk say Mr. Bazoum, wey be 63 years old, don lose “worrying” amount of weight, and him 20-year-old son, wey get chronic medical condition, no get access to care.

Meanwhile, one meeting wey dem plan make West African chiefs of defence staff meet to discuss di coup for Niger don postpone for di weekend. ECOWAS bin call di talk wey dem suppose hold for di Ghanaian capital, Accra, on Saturday. Dem no give reason why dem postpone am.

More Posts