Nigeria Intervention Team wey dey include big Islamic scholars for the country bin meet wit di leaders wey do di coup for Niger during di weekend. During di meeting, both sides agree say dem go put more effort for dialogue to solve di political wahala for dat country.
Di Islamic Ulammas wey Sheik Bala Lau dey lead bin meet wit General Abdourahmane Tchiani for plenty hours for Niger capital, Niamey. For di meeting, dem talk about all di kasala wey dey, including di demand by ECOWAS leaders say make dem bring back former President Mohamed Bazoum. Bala Lau bin talk say dem clerics bin show face for Niger sake of President Bola Tinubu wey agree say make dem intervene. E explain say di reason why dem visit Niger na to yarn well-well wit dem, make dem encourage General Abdourahmane Tchiani and oda military leaders wey dey support di coup, make dem choose peace instead of war to solve di wahala. General Tchiani bin respond and talk say he dey open to explore diplomacy and peace to solve di matter. But he also yan say e pain di coup leaders well-well say ECOWAS leaders no hear dem own side of di story before dem give dem small time to pack comot from office. E still yan say di coup bin dey well-intentioned, and dem bin do am to prevent wahala wey fit affect not only Niger Republic, but even Nigeria self.