Niger Leader Wey Do The Takeover, Gen Tchiani Don Put Hand For Chest Tok Say E Go Handover Power In Three Years.

August 22, 2023


Di leader of di coup for Niger, Gen Abdourahamane Tchiani, don promise say him go return di West African nation back to civilian rule inside three years.

Gen Tchiani wey yan dis tori afta him meet di mediators from di West African regional bloc ECOWAS for di capital, Niamey, no tok how di handover of power go happen, but him talk say dem go decide di principles wey go guide di transition for inside 30 days for one “dialogue” wey di coup leaders go arrange. ECOWAS bin reject di three-year time wey dem give, afta dem hold talks on Sunday. Dem talk say e go better for dem to quick give power back to civilians and focus on their main work wey be to defend Niger’s territorial integrity. ECOWAS don threaten military action to overturn di coup wey happun last month wey remove President Mohamed Bazoum if di talks no work. However, di head of di junta don yan say Niger no dey interested for war but dem go defend demselves if any foreign intervention show.

More Posts