NDLEA don talk say make all di commands and formations of di Agency begin immediate clampdown on top di illegal sale and use of NITROUS OXIDE wey dem dey call laughing gas sake of say pipo dey misuse am for enjoyment.
Di Chairman/Chief Executive of di Agency, Brig. Gen. Mohamed Buba Marwa (Retd), wey yan dis tori, say dis nitrous oxide na colorless gas wey people dey use well well for sedation and pain relief, mostly by dentists and medical professionals to sedate patients wey dey do small small medical procedures.
NDLEA sef talk say dem take decision to clampdown based on di analysis wey dem do on top di effects wey dey affect pipo wey dey misuse di substance. Some of di effects include: dizziness, confusion, headache, lightness for head, fainting and odas wey dey affect brain especially psychiatric symptoms.