The Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC) tok say dem dey aware of the ongoing outbreak of Ebola Virus Disease (EVD) Sudan strain and wetin e don cause for inside Uganda.
The Director-General, NCDC, Dr. Ifedayo Adetifa, for inside statement wey dem give News Agency of Nigeria (NAN) in Abuja on Tuesday, Uganda been declare say the virus don burst out, say dem dey already shine dia eye.
Dem say na the Sudan strain of the Ebola virus dey cause the EVD, after e don cause outbreaks before before for Uganda, South Sudan, and Democratic Republic of Congo.
As at Sept. 29, the Ugandan Ministry of Health don report 54 case dat is (35 confam and 19 possible case) and 25 deaths dat is(7 confam and 18 possible death).