NCC Don Order Telecomms Make Dem Ban Any Person Wey Wan Carry Shoulder Say Dem No Go Link Dea Telephone Numbers To NIN

February 29, 2024

The Nigerian Communications Commission (NCC) don give directive to telecom service providers say make dem block subscribers wey no link their phone numbers to their National Identification Numbers (NIN) on or before February 28, 2024.

The Executive Vice Chairman of the Commission, Aminu Maida, talk this one through the Director of Public Affairs, Ruben Mouka, for the 45th Kaduna International Trade Fair on Wednesday.

E talk say as a matter of critical national security, telecom users must link their NIN to their SIM cards.

Maida talk say the February 28th deadline wey NCC give to telecom operators to block subscribers wey no link their NIN to SIM cards, still dey valid.

E emphasize say NCC dey committed to protecting the rights of consumers and ensuring their satisfaction, and dem create an environment wey fit make people access affordable and fair service wey go support the economic growth of the nation.

More Posts