Minister Of Works Don Point Finger Give Bad Belle Pipo, E Tok Say No Going Back For The Use Of Concrete For Road Buildings. 

October 11, 2023

Minista for Works, David Umahi don yan say e go chase comot any pesin wey dey cause wahala for di Federal goment plans to use concrete pavement for road construction for Nigeria. E talk dis one afta e waka come out from meeting wey e do with President Bola Tinubu for Presidential Villa for Abuja. Di Minista talk say dem dey serious about improving Nigeria road, and dem don approve some important requests. E still give contractors 14 days to begin use concrete pavement. E say roads wey dem build with concrete dey last well, no too need plenty maintenance, and e dey help di economy. E warn contractors say dem must make sure asphalt roads last at least 15 years and dem must get assurance from good insurance companies. If contractors no follow di law wey dey ground for road projects, e fit revoke dia contracts. E talk say President don approve make consultants, engineers, and task force dey every site from Lokoja, Benin, Warri, Cross River, and other parts of Nigeria to check how contractors dey work.

More Posts