The Federal Government and major cement manufacturers don fix the price of 50kg bag of cement for between N7,000 and N8,000 depending on the location for the country.
Senator David Umahi talk this one after dem get meeting with major cement manufacturers on Monday for Abuja.
Dem come agree say dem go sell 50kg bag of cement for between N7,000 and N8,000, depending on the location.
But, dem talk say the price go drop from the current market price, depending on if government go fit fulfill some interventions wey go help solve the critical wahala wey dey for the industry.