Leaders of the National Union of Electricity Employees (NUEE), don announce the suspension of dia ongoing strike by two weeks.
FCT chapter Chairman, Mr. Godfrey Abah, tok so for interview with tori pipo late yesterday say the suspension come after a meeting wey dem do with Ministers of the government, including Sen Chris Ngige, and Abubakar Aliyu, with oda stakeholders.
He say dem present all the whole issues and dem even arrange confam delegation to look into the matter well and bring back report card within two weeks.
Remember say the NUEE been direct all dia members to stop work from Wednesday August 17 for inside notice wey dem write and sign by dia General Secretary, Mr. Joe Ajaero.
For meantime so, the Transmission Company of Nigeria on Wednesday, tok say dem been vex quench the national grid after the industrial gbege wey the two in-house unions of the company get.
For statement wey TCN dia General Manager, Public Affairs, Mrs. Ndidi Mbah give, she tok say the gbege happen around 3:01p.m for afternoon on Wednesday, when some union members vex go quench plenty of the 330kV transmission lines and 33 Kilo Volt (kV) feeder-lines across the power system network.
Dem no sha give any update weda dem don on the power system network back, or weda dem don restore the national grid to normal.