The Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don warn motorists make dem dey maintain di speed limit while dem dey drive for di long stretch of di newly-renovated Third Mainland Bridge.
Di General Manager of LASTMA, Mr. Olalekan Bakare-Oki, wey give di warning for one statement, talk say di bridge wey dem don repair well well dey look so nice and fascinating to drive on without any wahala.
E talk say dis fit dey too tempting and risky for motorists if dem no observe di speed limit, and dis fit lead to bad tins for dem.
Di general manager still talk say di goment don put better facilities wey go help motorists to navigate di whole bridge reach where dem dey go within reasonable travel time.
Di Third Mainland Bridge suppose open for traffic today, April 4.