The 14th Emir of Kano, Sanusi Mohammed, don meet di military leaders wey stage coup two weeks wey don pass for Niger. Di former Central Bank of Nigeria Governor don yan dis one afta im waka go see President Bola Tinubu on Wednesday to give am tori about im effort to settle di wahala wey dey for di neighboring country. E come meet di Niger coup leaders afta ECOWAS, African Union, and top US diplomat try but dem no fit settle di mata. According to Sanusi, e talk say e no fit make government alone handle di wahala wey dey Niger, say Nigerians and Nigeriens gots dey involved for find solution. E talk say e decide to do dis peace move on im own using im personal connections, and e go still continue to try im best as leader.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905