Lagos don increase di money wey dem dey give for bursary and scholarship to their pipo wey dey from di state

March 6, 2024

Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don announce say e dey increase Bursary Awards for indigenes of di state wey dey for tertiary institutions to Sixty thousand Naira and Scholarships to Two hundred and Twenty-Five thousand Naira.

Di Governor tok dis one for inside one meeting wey dem call with students for Alausa, Ikeja. Di meeting get di theme wey be “Students as Strategic Partners in di Governance Process: Challenges and Prospects for Youth Development” and e dey part of im administration commitment to carry youths along according to im T.H.E.M.E.S PLUS Developmental Agenda.

Governor Sanwo-Olu also appoint four former Students’ Union leaders – Eniola Opeyemi, Kayode Samuel, Giwa Moore, and Adeola Adewunmi – as im Special Assistants.

Governor Sanwo-Olu, wey list different interventions and programmes of im administration for di tertiary education sector, emphasize di need for collaborations to build solid Student-University-Government relationship.

Di Commissioner for Tertiary Education, Mr Tolani Sule, wey give welcome address boast say di academic calendar for state-owned institutions no dey disrupted even during Covid.

E assure students say dem go continue to commit to ensure say academic excellence dey.

Our correspondent wey dey report dis mata talk say Student Union leaders from thirteen tertiary institutions for di state, including Lagos State University, Lagos State University of Science and Technology, University of Lagos, and Yaba College of Technology, among odas, attend di interactive session.

More Posts