Lagos Don Confam Plenty Burial For 103 Pipo Wey Peme During The #EndSARS, Explain Say None Come From Lekki Tollgate.

July 24, 2023

The Lagos State Government don yan say the tori wey dey fly around about dem approving N61,285,000 for the mass burial of 103 persons wey be 2020 EndSARS victims na lie, and the people wey dem wan bury no be from the controversial Lekki Tollgate shooting. The memo wey leak and date July 19, 2023, wey show how dem wan process the money after the State Governor approve am, cause plenty reaction for social media.

The Permanent Secretary for the Ministry of Health, Dr. Olusegun Ogboye, come talk say the letter dey true, but people misunderstand am. According to am, the victims wey dem wan bury na from different incidents of violence wey happen after the EndSARS protests across the whole state.

Ogboye still talk say dem no see any body for the Lekki Toll Gate incident. Instead, na the Lagos State Environmental Health Unit (SEHMU) recover bodies from areas like Fagba, Ketu, Ikorodu, Orile, Ajegunle, Abule-Egba, Ikeja, Ojota, Ekoro, Ogba, Isolo, and even from the Ikoyi Prison during the jailbreak.

More Posts