King Charles of England don get diagnosis wey e get one kind cancer. Buckingham Palace talk say no be prostate cancer, but dem discover am when dem dey treat am for enlarged prostate.
Dem never talk di exact type of cancer wey e get, but according to statement from di palace, di King don start “regular treatments” since Monday.
Buckingham Palace still talk say di 75-year-old King go continue to dey do im other official duties, including im weekly meetings with di Prime Minister and im usual daily paperwork.
Dem talk say dem no get any plan to appoint Counselors-of-State to dey act on im behalf, wey go mean say di King no fit carry out im duties because of sickness.
Our correspondent, Immanuel Odeyemi, yan say palace officials talk say King Charles don waka come back to London from im country residence for Sandringham to begin di cancer treatment as outpatient.