Doctors for Kenya don start one week strike sake of say government dey delay to deploy medical interns.
Dem dey also complain about di poor working conditions wey dem dey work under.
Di Labour Court bin don issue one order to stop di industrial action make dem fit negotiate between di labour minister, di doctors’ union, and di employers today to find solution.
But di union talk say dem no receive di court order.
Kenya dey face one big public health crisis. With doctors for state medical facilities on strike, patients wey need help go suffer.