INEC don fix November 2025 for Anambra governorship elections

INEC don fix November 2025 for Anambra governorship elections

October 18, 2024

INEC chairman, Prof. Mahmood Yakubu, don talk say di off-cycle governorship election for Anambra go happen on November 8, 2025. E yan this one during meeting wey dem get with political parties for Abuja. E talk say di election go happen for 5,720 polling units across di state, and dem go publish di formal notice on November 13.

Prof. Yakubu also talk say party primaries go run from March 20 to April 10, 2025, while di nomination process for candidates go start on April 18 and close on May 12. Political campaigns go begin on June 11 and finish for midnight on November 6, 2025.

Our correspondent, Raliat Adenekan, report say Professor Yakubu also talk say dem dey prepare well well for di governorship election wey go happen for Ondo State on November 16, 2024. E don urge voters to pick dem Permanent Voter’s Cards from yesterday, October 17, go October 29.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/new-basic-school-curriculum-go-start-nationwide-from-january/

More Posts