INEC Chairmo Don Come Outside To Ginger For Safe and Tight Environment During The Elections Wey Go Shele’ Very Soon

January 24, 2024

As preparations dey go on for the re-run elections and bye-elections wey dem schedule for Saturday, February 3, 2024, the Chairman of the Independent National Electoral Commission (INEC), Prof. Mahmood Yakubu, don talk say e dey important make dem get secure environment for peaceful elections.

The INEC Chairman yan dis one today for one Inter-Agency Consultative Committee on Election Security (ICCES) meeting wey happen for the commission’s headquarters for Abuja.

E express concern about the possibility of threats and disruptions from political parties, and e call for readiness to handle any events wey fit happen.

The Director of Internal Security Office, Hassan Abdullahi, wey dey represent the National Security Adviser (NSA) for the ICCES meeting, emphasize the importance of collaboration among security agencies to ensure say the environment dey secure and peaceful during elections.

The Inspector-General of Police (IGP), Olukayode Egbetokun, also assure Nigerians say dem go put comprehensive security measures for ground before and during the upcoming elections.

More Posts