IG Olopa Don Order Proper And Full Torchlighting Into The Attack Ontop One Officer For Abuja. 

September 29, 2023

The Inspector-General of Olopa (I-G), Mr Olukayode Egbetokun don order full and proper torchlighting into the attack of one olopa officer, Insp. Omeje Matthew for Abuja. The Force Public Relation Officer, ACP Olumuyiwa Adejobi tok dis one for one statement, e tok say the I-G give the order when e go visit the officer wey don dey the National Trauma Center, National Hospital, Abuja. Egbetokun tok say the visit wey him do na to look the condition of the officer wey the agbero’s matchete kpa-kpa-kpa anyhow with no mercy inside him house for Kabusa area of Abuja. E order the Commissioner of Olopa (CP) wey dey in charge of FCT make e carry out proper and full torchlighting on top the matter to make sure say dem do quick catch dese wicked pipo and give dem the right punishment dem suppose get. 

More Posts