House of Representatives don direct Central Bank of Nigeria (CBN) make dem suspend di new ATM transaction charges and di removal of free ATM withdrawals for customers wey dey use other banksβ ATMs.
Di Green Chamber adopt di motion wey Marcus Onobun sponsor, say make dem pause di new CBN ATM policy until dem don engage properly with di relevant House committees, because e go add more financial wahala for Nigerians.
Meanwhile, di House still direct Nigerian Communications Commission (NCC) make dem force all internet service providers to block all pornographic websites for di country immediately.
Di lawmaker from Katsina State, Dalhatu Tafoki, wey move di motion, talk say cyber pornography don turn global problem, and Nigeria never do enough to stop am.
As dem adopt di motion, Speaker Abbas Tajudeen wey preside over di plenary, mandate di relevant committees make dem follow up di matter and report back within four weeks.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/senate-don-tell-inec-make-dem-do-by-election-for-edo-central-anambra-south/