Former Ivory Coast President Laurent Gbagbo has agreed to fly his party's flag as presidential candidate in the 2025 elections

Former president Laurent Gbagbo don gree say e go contest di 2025 Ivory Coast election

March 11, 2024

Former Ivory Coast President Laurent Gbagbo don agree to run as presidential candidate for di 2025 elections on di platform of im party, di African People’s Party – Cote d’Ivoire (PPA-CI).

Dis informate comot from Katinan Kone, wey be di spokesperson for Gbagbo party, afta dem hold meeting for di party central committee for di weekend.

Gbagbo bin lose control of di party wey im bin found, di Ivorian Popular Front (IPF), while im bin dey imprisoned dey wait trial for Netherlands for some years, but people believe say e still get large and loyal support for di country.

Di next election for di West African country go likely happun for October 2025. President Alassane Ouattara, wey be 82 years, and wey win election for 2020 never talk whether e go run again.

More Posts