FG meeting with ASUU don shift go August 28

August 27, 2024

The meeting wey dem plan between Federal Government and Academic Staff Union of Universities (ASUU) to stop another nationwide strike, dem don postpone am. ASUU President, Emmanuel Osodeke, confirm say the meeting wey suppose hold today Monday no go happen again, and dem don shift am go Wednesday, August 28.

Even though dem no give reason for the postponement, make we remember say last week, ASUU threaten say dem go start nationwide strike because dem talk say the Federal Government no wan honour the 2009 renegotiated agreement, welfare issues, funding for universities, and make dem stop to dey build new universities for the country.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/nigeria-go-hold-di-54th-art-culture-and-creative-economy-summit-on-monday/

More Posts