Di Minister of Works, David Umahi, don talk say di Lagos-Calabar coastal road construction go take eight years to complete and go cost N4bn for each kilometre, and not di N8bn per km wey former Vice President Atiku Abubakar bin claim.
Dis one mean say di total project go cost N2.8 trillion.
Umahi, wey yarn for one interview, still talk say dem get plans to recover di money through tolling wey go cost around N3,000 per toll gate on average, when di coastal road finish.
Di minister also rubbish claims say di project no follow due procurement process, as e talk say di contract award na based on counter-funding arrangement and no be Public-Private Partnership as pipo dey claim.
Atiku bin question President Bola Tinubu administration say why dem allegedly give di contract to Gilbert Chagoury’s Hitech without competitive bidding, and e challenge di president make im disclose di full cost of di Lagos-Calabar highway project.