Federal Government Go Close The Third Mainland Bridge For 24 Hours To Take Carry-out Some Repairs.

October 20, 2023

The Federal Government don carry mic yarn us say dem wan close the Third Mainland Bridge for Lagos State starting from midnight of Saturday, October 21st go midnight of Sunday, October 22nd so dem go fit carry out some repairs for the bridge. Lagos State Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, for one statement, tok say the Federal Ministry of Works, wan join-body with Lagos State, to take do correction on some serious areas of the 3rd Mainland Bridge wey lead inside Lagos (Island and Mainland). Dem don dey advise pipo wey get motor, wey wan use the 3rd Mainland Bridge take connect Lagos or wherever dem wan go, make dem use another direction, but motor users wey dey comot outside Lagos Island dey free to use the 3rd Mainland Bridge since na only pipo wey dey go inside Lagos the go-slo go disturb because of the bridge dem wan close for the meantime.

More Posts