Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, don direct make dem do full investigation into di allegations of bribery and corruption wey dey inside Nigerian Correctional Service. As e give di order for statement yesterday, di Minister condemn di alleged behaviour, and e emphasize say any form of indiscipline, unprofessionalism, and corruption no go dey tolerated at all, and anybody wey involve go face serious consequences for paramilitary services under im control.
Dis order follow di bribery allegation wey Idris Okuneye, wey people sabi as Bobrisky, make for one video wey blogger, Martins Otse, wey dem dey call VeryDarkMan, release. Di allegation dey against one top officer for Nigeria Correctional Service and EFCC.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/cbn-don-increase-interest-rate-to-27-25-percent/