Super Eagles striker, Victor Osimhen don get green light from di team medical doctor for di match wey e go play against South Africa later today.
If you sabi, Osimhen bin miss Super Eagles trip go Bouake, wey be di venue for di semi-final match against South Africa, after e bin dey suffer abdominal discomfort.
But reports wey dem get from Abidjan don show say Osimhen don pass im fitness test wey e get late, and e don travel go Bouake to join di rest of di squad.
Di 25-year-old don start for all of Super Eagles five matches wey dem play for Cote d’Ivoire, and e don score one goal against Equatorial Guinea, and e still play key roles against hosts Ivory Coast, where e win decisive penalty, and set up Ademola Lookman against Cameroon.
Di AFCON semi-final match between Nigeria and South Africa go happen by 6:00pm today Nigerian time.