Harry Kane score two goals wey help Bayern Munich overturn di first-leg deficit against Lazio and advance to di quarter-finals of di Champions League.
Dem bin dey trail 1-0 from di first leg wey dem play for Rome. Kane header make di scores level for aggregate, before goals from Thomas Muller and anoda one from Kane make am 3-1 for aggregate.
For anoda side, Kylian Mbappe score two goals as Paris St-Germain waka enta di quarter-finals of di Champions League, dem knack Real Sociedad. PSG bin lead 2-0 from di first leg, and win 2-1 last night to end di tie 4-1 on aggregate. Di quarter-final draw go happen on Friday, March 15.