Asisat Oshoala and Chiamaka Nnadozie dey among di final ten nominees for CAF Women’s Player of di Year, ahead of di 2023 CAF awards wey go happen for Marrakech, Morocco, on December 11. Dem release dis information through CAF X account.
Oshoala bin win di CAF Women’s Player of di Year award for 2022, beating Grace Chanda of Zambia and Ajara Nchout Njoya of Cameroon, and dis go be her fifth time to dey nominated.
Super Falcons head coach, Randy Waldrum, dey nominated for di Coach of di Year category, while Deborah Abiodun and Esther Ajakaye also dey among di finalists for di Best Young Player of di Year. Super Falcons team sef dey among di finalists for Women’s National Team of di Year.