Ova 10 million pipo don sign up for Threads, Meta’s rival to Twitter, within di first few hours of di launch. Mark Zuckerberg, di CEO of Facebook parent company, don confirm dis on Thursday as di app go live for Apple and Android app stores for 100 countries, and for now, di app no go get ads.
Threads dey pose as di biggest competition so far to Elon Musk-owned Twitter, wey don see oda potential competitors but none don fit replace am.For di oda hand, Twitter don threaten to sue Meta just few hours afta Instagram parent company launch Threads. For letter wey Alex Spiro, Musk’s lawyer, send give Meta CEO Mark Zuckerberg, e accuse di company say dem don employ dozens of former Twitter employees wey “get and still get access to Twitter’s trade secrets and oda highly confidential information.” Di letter also accuse Meta of “unlawful misappropriation of Twitter’s trade secrets and oda intellectual property.”