Adamu Adamu Deny Say Presido Buhari Give Am Two-week Ultimatum to Settle ASUU Strike

August 19, 2022

The Minister of Education, Adamu Adamu don deny say presido Buhari give am two-week ultimatum to settle the long ASUU strike.

The Minister wey dis levuls for the 47th session of the State House Ministerial Media Briefing for Aso Rock Villa, Abuja, also tell students to carry ASUU go court for compensation over the time wey dem don sidon for house lost since the University teachers start dia latest strike.

He tok say the Presido tell am to settle the mata within the shortest possible time, complete opposite of wetin the Minister of Labour and Employment, Chris Ngige open mouth tell tori pipo, while he declare say five of the striking university-based unions go go back to work in the next one week, while for ASUU mata water don pass garri.

He insisted say he no go fall mugu to ASUU demand of say make dem pay dia members the backlog of salaries wey dem hold inside the six months wey dem dey on strike, say dat one na the punishment for dia action.

ASUU been start one-month warning strike on February 14. But the union don increase am plenty times for the past six months.

More Posts