Abuja High Court don confirm say Abure na Labour Party National Chairman

October 9, 2024

Federal High Court for Abuja don return Julius Abure as Labour Party National Chairman. As Justice Emeka Nwite give the judgement yesterday, e declare say the 2024 Labour Party national convention wey dem do for Nnewi, wey re-elect Abure, dey valid, and e follow all the laws for Nigeria.

For statement wey the party’s National Publicity Secretary, Obiora Ifoh, announce, Justice Nwite still order INEC make dem give full recognition and all privileges to the Labour Party’s National Working Committee, wey Abure dey lead.

Abure don extend olive branch to Peter Obi and other members wey dey vex, as e believe say the judgement go be foundation for other rulings, to show the strength and fairness of Nigeria judicial system.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-start-to-dey-repair-sagamu-ijebu-ode-expressway/

More Posts