US Supreme Court don rule say Donald Trump go still dey Presidential Ballot

March 5, 2024

The US Supreme Court don quash efforts wey individual States make to stop Donald Trump from running as presidential candidate for November election.

The Justices unanimously cancel Colorado decision to disqualify Trump from the Republican primary ballot.

Judges for the state bin talk say make dem use anti-insurrection clause for US Constitution ban Trump; similar efforts don happen for Illinois and Maine.

The Colorado ruling bin talk say Trump actions around the January 6 attack on Capitol by hin supporters bin dey reason for the ban.

But in their decision wey dem announce on Monday morning, Justices talk say na only Congress get power to enforce the provision, not states.

More Posts