UN Security Council don lift di territorial arms embargo wey dem put for Central African Republic since 2013 after civil war start. But di foreign minister for di country talk say di embargo don turn “unjust.”
Di resolution wey dem adopt unanimously don cancel di sanctions wey dem don already reduce last year when Security Council members agree make government forces dey exempt from di embargo.
But even as dem lift di territorial embargo, di move wey dem do on Tuesday come introduce another ban on sales to “armed groups” wey dey operate for di country until di end of July 2025. Dis one na measure wey don already dey in place.
Civil war don disturb di former French colony since one Muslim-dominated armed coalition wey dem call Seleka overthrow former president Francois Bozize for 2013.
READ MORE RECENT NEWS HERE