New tori wey just land talk say UK goment don show dia plan to reduce foreign aid money wey dem dey give out, and di biggest cut go touch Africa, especially for children education and women health matter.
Di goment talk say from February dis year, dem don decide to slash di aid budget from 0.5% of Gross National Income (GNI) to 0.3%, so dem fit pump more money enter defence.
Dis move come after US President Donald Trump bin already approve major cut for US foreign aid, wey include shutting down USAID di agency wey dey run plenty global help programs.
BBC report say Africa go suffer well from di US cuts, especially people wey dey struggle with HIV/AIDS, tuberculosis, and mama-pikin health wahala.
UK Foreign Office own report show say Africa go carry di biggest blow, and dat one fit increase disease risk, wahala with clean water, and health crisis for women and children.
One big UK aid network, Bond, talk say:
“Na di most vulnerable women and children for places wey dey suffer pass go pay di biggest price for dis kind political decision. E pain say aid for Africa, gender, education and health go reduce.”
Instead of helping more, UK dey step back when dem suppose dey step forward — especially now wey US don cut gender programs finish.
Di UK goment say dis cut na after dem do line-by-line check of how dem dey spend di aid money. Dem talk say dem go protect humanitarian support wey don already plan and make sure dem pull out from programs responsibly where e necessary.
Dem never talk exactly which countries go feel di cut pass, but dem say some bilateral help go reduce and any organisation wey no dey deliver well go lose money.
Before now, if UK dey spend 0.5% of GNI, aid money go reach £15.4 billion by 2027. But with dis new 0.3% plan, e fit drop to around £6.1 billion.
Some politicians support am say defence need more funding, like Kemi Badenoch and Ed Davey. But Davey warn say if aid budget too low, Russia and China fit jump enter gap wey UK leave.
Meanwhile, former International Development Minister Anneliese Dodds resign because she no gree with di decision. She talk say UK fit waka comot from many African, Caribbean and Balkan countries at di same time wey Russia and China dey increase their influence there.
According to Prime Minister Keir Starmer, govment go use di money wey dem save from aid funding to increase dia defence spending to 2.5% of dia GDP by 2027 and 3% by 2030.
E mean say di UK go dey spend extra £13.4 billion on defence from 2027.
Anoda reason, according to di UK Trade Minister Douglas Alexander, be say di money no too dey again and di UK public no longer support too much spending on international aid.
Even if moni no dey tight, you go need to make di argument for investment in foreign aid, oga Alexander tell BBC for one interview in June.
“I tink we don lose dat argument at various points. We get interest to build a stable, more equal, more safe world for our future generations, but public consent don withdraw,” e tok.