Tobi Amusan and oda athletes go do compulsory gender test before 2025 world championships

July 31, 2025

Nigeria sprint hurdler and world record holder, Tobi Amusan, go dey among female athletes wey gatz do compulsory genetic gender test as World Athletics don introduce new rules ahead of 2025 World Championships wey go happen for Tokyo.

Based on di new rules wey di global body release, any athlete wey wan compete for female category must do one-time genetic test from September 1, 2025, to confirm say dem be biologically female. Di test go check for SRY gene wey dey normally for Y chromosome, and dem go do am either with cheek swab or blood sample.

President of World Athletics, Sebastian Coe, talk say di new policy na to make sure say sport dey fair for women.

“We dey talk say for elite level, if you wan run for female category, you must be biologically female. E clear for me and di World Athletics Council say gender no fit pass biology,” Coe talk.

“We wan thank our Member Federations for di support and commitment to make sure say these new rules go work.”

Di rule na product of di Gender Diverse Athlete Working Group work, and e gather all di former rules about transgender and DSD (Differences of Sex Development) athletes into one uniform requirement for all female athletes.

Amusan, wey be 2022 world champion and current 100m hurdles world record holder, dey prepare to defend her national title for Nigerian Championships wey go happen for Lagos from August 1–3, as part of her preparation for di Tokyo event wey go start September 13.

More Posts