President Bola Tinubu don yan di Business community for Saudi Arabia say all di wahala wey dey stop Nigerian economy from dey easy to do business, for monetary policy, and trade cooperation, e don clear now.
Di statement wey im Media aide, Ajuri Ngelale, release talk say Tinubu yan dis one during Nigeria-Saudi Investment Roundtable for Riyadh. Tinubu talk say im dey optimistic about free market economics and say all di wahala around di nation’s foreign exchange policy and corruption don pass.
Im con talk say Nigeria don open for business and e reassure di leaders for Saudi Arabian Industry say with im team, Nigeria dey succeed for di matter of economic policies wey dem dey use change di country economy.
Saudi Arabia’s Trade and Investment Minister, Kahlid El-Falih, yan say dem see di passion and open talk from di Nigerian leader and e talk say Nigerians go see results as di Saudi investment community go put substantial new money for different parts of Nigerian economy.