The Federal Government apply to withdraw di charge wey dem file against the suspended governor of the Central Bank of Nigeria.

August 16, 2023


Yesterday, di Federal Government apply to withdraw di charge of illegal possession of firearms wey dem file against di suspended governor of di Central Bank of Nigeria, Godwin Emefiele. Director of Public Prosecutions for di Federal Ministry of Justice, Mohammed Bakodo Abubakar, wey approach di federal high court for Ikoyi with oral application, yan sey dem wan withdraw di charge based on new investigations wey dem do. But Abubakar still talk sey dem don file new charges wey get 20 counts against Emefiele for di Federal High Court for Abuja. Abubakar tell journalists dis tori afta di proceedings for di court. Emefiele bin dey arraigned last month on top two-count charge wey concern “illegal possession of firearms” for one federal high court for Ikoyi, Lagos.

More Posts