Super Eagles Go Play Mozambique For International Friendlies Without Dem Osimhen And Iheneacho.

October 16, 2023

Dem talk say Victor Osimhen and Kelechi Iheanacho no go fit play for the Super Eagles for their friendly game against Mozambique. Dem update this one for the team’s official social media handle on Sunday.

Osimhen bin wakka comot for Friday’s 2-2 draw against the Green Falcons of Saudi Arabia, and the team talk say e no go dey the game against Mozambique as a “precautionary measure” based on medical advice.

As for Iheanacho, dem excuse am because e get “pressing personal issues” wey e need to attend to. The game between Nigeria and Mozambique go happen for Estadio Municipal de Albufeira, Portugal on Monday by 4 p.m. West Africa Time.

More Posts