Serious Heatwave Dey Roast: Europe Two Don Die for Italy, Wildfires Dey Burn Turkey

July 2, 2025

Hot sun don land heavy for Europe as countries like UK, Spain, Italy, Portugal, France and others dey face one of di worst heatwaves in recent years.

For Italy, two people don die from heat-related wahala, while Portugal and Spain don record dia hottest June ever. For Portugal, temperature reach 46.6°C for one town called Mora, wey be di highest June temperature ever recorded for di country.

UK sef no left out, as dem record di hottest day of di year with 33.6°C for Frittenden, Kent, according to Met Office.

Spain national weather agency, Aemet, talk say June 2025 hot pass wetin dem dey expect even for July or August. Some parts of Iberian Peninsula see temperature pass 43°C, and night temperature no even cool down — 28°C for Seville, 27°C for Barcelona.

Wildfires Dey Worry Turkey

For Turkey, wildfires don scatter plenty areas. Over 50,000 people don evacuate from Izmir and other provinces like Bilecik, Hatay, Sakarya and Manisa. Di Forestry Minister, Ibrahim Yumakli, say emergency teams don respond to 263 wildfires in just three days.

France Close Eiffel Tower, Schools

France experience dia hottest June night and day on record. Dem even close di top of Eiffel Tower for Paris because of di heat. Di government activate red alert for Paris and 15 other regions, and dem close over 1,300 public schools on Tuesday.

Climate Minister Agnès Pannier-Runacher call di situation “unprecedented.”

Italy and Greece Still Dey Boil

For Italy, hospital admissions don rise by 20% for Tuscany, and 21 out of 27 cities dey under highest heat alert. Authorities don warn people for Lombardy and Emilia make dem no go outside during di hottest time of di day. For construction sites and farms, dem ban outdoor work from 12:30 to 16:00 until September.

Greece too dey roast with temperature near 40°C, and wildfires don hit towns near Athens, destroy houses and force people to run.

More Posts