Senate don talk say dem go look into di yans wey Niger Republic Head of State make against Nigeria

Senate don talk say dem go look into di yans wey Niger Republic Head of State make against Nigeria

February 7, 2025

Nigeria Senate don agree to investigate di allegations wey Head of State of Niger Republic, Brig. Gen Abdourahmane Tchiani, make against Nigeria. Him accuse Nigeria sey di country dey work with France to destabilize Niger using a new militia group wey dem call Lakurawa.

Dis one follow after Bauchi South Senator, Umar Shehu, bring di motion for yesterday’s Plenary.

Senate Leader, Sen. Opeyemi Bamidele, and Senator Seriake Dickson, in their contributions, talk say Senate suppose step in to recommend diplomatic and security measures wey go help restore and strengthen di historical relationship between Nigeria and Niger.

Because di matter dey sensitive, Senate decide say dem no go hold open debate on di allegations but dem direct di committees on National Security and Foreign Affairs to carry out investigation and report wetin dem find.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-wan-make-education-system-follow-12-4-model/

More Posts