Senate on Thursday don approve di $800 million World Bank loan request by President Bola Tinubu.
For di letter wey di President write, President of di Senate, Godswill Akpabio, read and explain say di loan go use scale up di National Social Safety Net Programme. Di World Bank facility go help federal government make unconditional cash transfer of N8,000 per month to 12 million poor and low-income households for six months. Dis go affect about 60 million individuals.
Just less than 24 hours afta President Bola Ahmed Tinubu make request for N500 billion to provide palliatives against fuel subsidy removal, di House of Representatives don approve di request by amending di Supplementary budget. Dis mean say di House grant di request wey di President make, and dis happen for di plenary wey happun yesterday.
Deputy Speaker, Benjamin Kalu, wey bin dey address di House of Reps Press Corps alongside oda Principal Officers, emphasize say wetin di House approve na to help reduce di impact of fuel subsidy on Nigerians, as dem wan make di effect no too hard for pipo.