Senate Don Call Federal Government Make Dem Pause The Plans Wey Dem Get To Take Comot The Shock Money From Electricity

February 22, 2024

Nigerian Senate don talk say make dem immediately stop the plan wey the Executive get to remove subsidy on Electricity, wey go lead to an increase for tariffs. Dem talk say the move no make sense and e no follow time at all.

The Senate con yan say make dem send their Power Committee to check the matter wey the Minister of Power, Adebayo Adelabu talk, say e need over N2 trillion as subsidy.

Dis one follow after the matter wey Senator Iya Abbas bring talk say the power sector dey owe over N3 trillion.

Senate President, Godswill Akpabio talk for the mata, talk say e dey in line with im colleagues on top the matter.

More Posts