President Bola Tinubu don charge Nigerian military and other security agencies make dem put more effort for controlling di many security wahala wey dey Nigeria.
Di President talk am through im Vice, Kashim Shettima, during di induction ceremony of two TK-129 ATAK Helicopters and one King Air 360i Aircraft at Nigeria Air (NAF) Base for Makurdi, Benue State.
Tinubu talk say im administration go still dey support di nation security forces by making sure say dem get better equipment, training, and welfare for dia personnel.
Chief of di Air Staff, Air Marshal Hassan Abubakar, wey talk for di event, talk say di Air Force dey do plenty work to overhaul dia operational platforms, equipment, and di whole environment so dem go fit dey more effective and deliver better service.