Police Rescue 19-Year-Old Boy Weh Climb Billboard for Kano Say E Wan See TikTok Star

July 2, 2025

Police for Kano State don rescue one 19-year-old boy wey climb billboard for Ado Bayero Bridge on Monday, say unless e see popular TikTok star Abdul BK, e go jump down.

Di boy, Ibrahim Abubakar from Adamawa State, climb di high billboard and refuse to come down, cause serious tension for di area. People gather as e dey shout say e no go come down unless e see di TikToker.

According to DSP Hussaini Abdullahi, wey be Deputy Police PRO, police and fire service rush go di scene after dem receive emergency call. Dem use talk-talk and beg-beg bring Abdul BK come di place. As Ibrahim see am, e calm down and agree to come down.

Dem carry am go Police Hospital for Bompai because e don weak from hunger, as e never chop for hours.

Commissioner of Police, CP Ibrahim Bakori, praise di rescue team for di way dem handle di matter and order full investigation. E warn say attempted suicide na crime for Nigeria, and beg people wey dey go through emotional wahala make dem find help from professionals instead of risking their life.

Police say dem go continue to protect life and maintain peace for di state.

More Posts